Dejafrique

don bring

Europe based Nigerian Guitarist, Singer and Composer 
Adedeji Adetayo come for concert wey him title AJO(the journey) for 16 November 2014 
VENUE: Ayo Bankole Centre for Arts in Surulere.

The concert go feature songs from hin album wey he release for 2012. The Album wey him also call ‘AJO; get traditional African style wey get 'progressive attitude' and new sound of jazz the music wey dem dey call funk inside, everything come join to give us music wey dey "rhythmically and technically broad" wey dey rich in harmony, melody and plenty of emotion.

Him record the album for 5 countries and put some of the best people around the world like the Lionel Loueke.

Him don perform with plenty artist like Lagbaja, Ayo bankolejnr, Sammie Okposo, Steve Rhodes Orchestra, Salvador Shango, Sound Sultan and for plenty festivals like, Apollo theatre(Greece),world music day(Greece),Documentary festival (Thessaloniki), African Art Fest(Madrid),Sing out gospel(Germany),Gideon festival(Netherland) , Swinging in Groningen and Kalamata jazz festival, Mamajazz festival Lithuania, Enclave De Agua festival Soria Spain and plenty boku boku ones dem.

The concert go take place for the Ayo Bankole Centre for Arts and musicians like  Adunni Nefretiti, Abiodun Batik, Saxtee(TundeBalogun) Victor Ademofe, SeunOwoaje , Taiwo Clegg, Dotun Bankole, Segun Atoyebi, Kayode Kuti, Wura Samba and plenty other people.

To enter the concert simple, make you just buy one copy of the CD wey dey available for the venue.

Make una come out come support good music!

Post a Comment

Previous Post Next Post