Ogbonge artist and business man, Dare Art Alade wey people dey also call Darey don come out with two Baddessst jam. The first na #AsikoLaye and him feature Olamide Baddoo on top am. The second one na #PrayForme where him feature multiple grammy award winner, Soweto Gospel Choir.

Dem dis song make sense die and Darey talk say make we dey expect him album next month. Dis 2015 na im mark 4 years wey Darey release album last.

Make una listen and enjoy the songs...

Listen to #PrayForMe



Listen to #AsikoLaiye







Post a Comment

Previous Post Next Post