Hosts of the event  Noble Igwe of  360 nobs online personality CuteKimani
For many Naija people on Friday the 27th of November na im be the day wey many stores wey dey our country do make people buy things cheap-cheap but this day come sweet join am as the company wey dem dey call Redington Nigeria Limited come arrange make bloggers come together for their Launch Apple iPhone 6s and iPhone 6s plus phones for Naija.
Person wey carry everybody come from Redington Nigeria na Mr. Stanley Igbinovia, Head – Retail & Operator Business, Telecom. wey him dey supported by Mr. Jim Mathews - Vice President Redington Gulf and Mr. Sunil Pangtey – Marketing Manager Redington Gulf.

Some other ogbonge people wey come support support Redington Nigeria na people wey dey representative where dem dey sell correct Apple iPhone 6S and iPhone 6s plus like Slot Nigeria, Pointek limited, Micro Station and Dallas Communications Limited.

Na Noble Igwe of 360nobs and Ogbonge on-air personality CuteKimani
host the event and dem make everybody enjoy demself wella.

The launch come carry the #iPhone6sNigeria hashtag for on top internet  and people follow am well well.
The new new thins wey dey inside the Apple iPhone 6s and iPhone 6s plus na im be 3d touch – wey be next generation multi touch – and na first time wey dem dey do am on top fone be dis. E get Live photos and come carry A9 Processor wey get the most advanced chip wey dey dis world, and the body na 7000 Series Aluminum alloy, and the fone come get Advanced Touch ID for better security and sharp sharp LTE and Wifi. All dis things truly show say Iphone 6s and 6s plus na baba.

Make una check foto of the plenty person wey come the place.

Bloggers dem


iammisslami & Lazywrita





CuteKimani, Kehny Obafemi (9jaupdates) and Noble Igwe (360 Nobs)






Mr Jim Mathews, Vice President  Redington Gulf & CuteKimani

Mr Phrank Rowland and Mr Stanley  Igbinovia Redington Nigeria limited

Noble Igwe 360nobs, Amaka Nwoko R  -Business Director Squad Digital , Barbara 1923

Unilag Olodo & DatGuyKofo


Post a Comment

Previous Post Next Post