DJ Obi, wey be one of the Ogonge DJ for Naija want break the Guinness world record for longest time wey DJ go take play music with him 240-hour play time wey him want attempt for Sao Cafe for Lekki. The history making event na im go happen from 10 P.M today,June 22nd to 10 P.M on July 1st, 2016.
The current record for Longest play time for DJ na 200 na for Dublin for Ireland for  November 19, 2014 the record happen but as from today, DJ Obi go try to comot that record for setting and put the Naija wey go be 240 hour for Sao Café for Lekki Phase One.
DJ Obi talk say, “This is a dream that we’ve been working on for over eight months. It means a lot to me and there’s no better way to show the world that Nigerian DJ’s are a force. I’m excited the day to finally get started is here. Lagos, I need your love and support so please come through to Sao Café. And all my Nigerian’s please hit me up on social media. Let’s go!
The award winning DJ Obi wey don worked for everywhere, from Naija, to Los Angeles and many many places for Obodo Oyinbo for him almost 10-years long career, don play with artist dem like Lupe Fiasco, 2face, Lynxxx, Banky W, M.I., Naeto C and many boku boku ones. With the many-many orishi-rishi music wey him get on top him hand with him versatile DJing style.
Make you keep up with the world record-breaking attempt for social media, as DJ Obi want try to put our Naija for map again:

#DJOBIWORLDRECORD

Post a Comment

Previous Post Next Post