Larry Dozie wey people dey also call Larry Hoova e pass ordinary rapper as e be say na him we fit dey call the Oga patapata for Trap music for inside Afrika.

Larry wey be say na 6th of December for inside Lagos Nigeria dem born am been start to dey do music for school with them him group wey don waka the 'Infidelz'.

This him new song "Little Naija Baby" wey be say na cover for Future's Little Haiti Baby been don dey released online for June 2016 and people gbadun am well.

As him don release this first video Larry Hoova plan to release him mixtape 'The Come Up' by December 2016. Make una follow Larry Hoova on top social media for @kinglarryhoova to dey get update on to him music and many more.


WATCH THE VIDEO


Post a Comment

Previous Post Next Post