These days nothing interesting dey happen for Naija. Abeg make dem do bring back our girls, the thing don dey tire person. No be my fault, na so people dey do; small time dem dey ontop your matter, small time dem don bone. No be politics carry me come here, na music. And so far so good, no better one dey my inbox.

Una no dey tire to sing nonsense? all these new new artste wey dey come out, wetin be una problem sef?   Seriously I wan understand. Una no get brain, abi una no get time? which one? For like three hours I don dey check the songs wey una dey submit for our inbox, na rubbish full am. why your life be like this?

I no say make una no sing Azonto o, but at least try make your own different na! even if na woman yansh you wan describe plenty ways dey do am. Abeg if una know any new person wey dey make better music, make una direct am come music[at]9jaupdates[dot]com.  I no wan believe say we no get correct musicians for this country. Abi how una see am?
أحدث أقدم