As the tori take enter my mouth and as i take dey feel when i dey listen to this gbedu na so i go take talk am.

This one na the new video from inside BlackMagic new Album wey go drop soon and the title na PASS YOU BY  ontop this song him bring the number misical taliban for our obodo Nigeria Oritsefemi.

I no go lie i like the corner wey musical taliban Oritsefemi take kpai the song, Oritsefemi i hail you wella Oga for WE RADIO you sef try. but small but they so far and this time na UNLIMITED LA bring the BUT enter the hashtag + those fonts we him use, oga ade you for fit do better pass this thing we you do but all the same people go enjoy the music because na good music but we for 9JAUPDATES Ogbonge tori place get eagle eyes and na our work be this from now..

So make una help me enjoy this good nusic from BlackMagic - Pass You By ft Oritsefemi. 


talk your mind too for this ogbonge tori


2 تعليقات

  1. My reaction to the hash tag fonts (see pic).


    I Like the video sha, the documentary approach make sense, but the execution no dey flawless. Black Magic no dey too pay attention to the quality of him videos. dem for fit avoid those small errors during post production. I still like the video sha like I talk before.

    ردحذف
  2. My reaction to the hash tag fonts! (see pic).

    I Like the video sha, the documentary approach make sense, but the execution no dey flawless. Black Magic no dey too pay attention to the quality of him videos. dem for fit avoid those small errors during post production. I still like the video sha like I talk before.

    ردحذف

إرسال تعليق

أحدث أقدم