Picture Credit: Anonymous

Wetin we dey hear be say YBNL don ready to release the album of Lil Kesh according to the picture wey we see wey dey go around on top BBM and twitter but we don find out say na joke.

Some bad belle people wey just like to dey cause yawa don dey spread picture say na only Shoki Lil Kesh fit sing because of the Shoki Female remix wey him just release but the truth be say the guy sabi rap too. Him prove am with the first single wey i hear am on for Lyrically.



After Lyrically, him come out with Last Card Freestyle wey also be correct song. 


Everybody know say na Shoki season we dey now as every artist self want do their own Shoki. We congratulate Lil Kesh say na him lead this new trend for Naija music.




Post a Comment

Previous Post Next Post