Chai! DerisGod o!!!! Make una see wetin Rihanna wear for the CFDA awards yesterday where dem present her with ‘Fashion Icon’ award say she sabi dress wella! The thin be like irony becos wetin dem dey try talk b say, fashion no be to cover body, as we all know am, even if you naked dis days, na fashion.

Na one oga wey dem dey call Adam Selman use 230,000 Swarovski crystal arrange the cloth for Rihanna.

Some people even suggest say she dress like dat to give instagram the middle finger because of how them take handle her nipple mata for their website. Some other people say the dressing dey provoke but some fashion people say Riri carry fashion go new level with luxury and high class.

Abeg wetin una think? Shey this one too much abi Ms Fenty as dem dey call Rihanna do beta with this her dress? Make una yarn…
















Post a Comment

Previous Post Next Post